If you be migrant or pesin wey dey seek for asylum for dis koro time, you must make sure say you get all de informate wey go helep you protect your sef and be safe.
Na for inside de World Health Organization WhatsApp Health Alert, na there you go get all de informate wey go helep you stay safe for dis koro time.
You go get all de informate about how you go take know de symptoms of koro and how pepul go take avoid de disease.
Dis service na free and you fit activate am if you follow dis steps wey dey very easy:
Since koro start, many countries don close their borders so dat pepul no go fit carry koro enter from outside and dis don dey affect migrants wey dey travel to such contries and even dose wey dey live for such borders. And becos of dis situation, many migrants now don dey stranded as dem no fit comot for such contries becos of lockdown.
Even govement and non-govement bodi wey dey helep pepul wey dey seek for asylum no fit do anything again; de thin dey affect dem also. And becos of all dis, pepul wey dey seek for asylum go pipe down becos small small thins wey go delay de processing of their paper don dey ground be dis koro.