Death for Mediterranean waka don reduce since 2018
International Organization for Migration (IOM) don talk say 21,981 waka people and the people wey wan become refugees for Europe don follow Mediterranean Sea enter Europe for the first 17 weeks for 2018.
E say na about 43 percent na im go Italy, 37 percent go Greece and remaining 20 percent waka enter Spain.
Record show say 44,625 people enter the region for the same period in 2017 and over 200,000 in 2016.The figures show say the number of waka people wey dey enter Europe through the Mediterranean don reduce well well. The number for this year no reach half of 2017 and na just about 10 percent of 2016’s for this same time.
The tori also talk say na about 606 people na im don die this year after dem don comot for Libya. E talk say the coast guard don gbab 4,964 waka people and carry them back to Libyan.
IOM come talk say from january 1 go reach end of April, 8,067 waka people don already enter Greece. That figure show say na average of 67 persons na im dey enter Greece every day for that period. E talk say the number of men, women and children wey don enter Spain through kurukere way for the same period na about 4,400. E say the number take small pass the last year own. But, the tori dey shout say the people wey don drown for inside the water as they wan enter Spain don increase weluwell. The tori say by April 29, 217 person don already drown as they want enter Spain but na only 224 na im drown for the whole of last year.
The tori say 9,406 waka people don enter Italy during this period, plus including 3,171 in April. The number take one quarter less the number for April 2017.
Photo Credit: www.sputniknews.com. See people wey wan rescue waka people for inside the Mediterranean
TMP – 19/05/2018
Regista for waka abroad informate
Make una share dis article