Everi day, pipu dey make de difficult decision to komot from deir homes for Nigeria for search of a beta future. Many dey risk deir lives trying to reach Europe thru Libya. Una dey think how to waka abroad or una don waka abroad already? Learn more about una legal options and de risks wey […]

Look am all

Blue Table Talk Episode 8

Blue Table Talk Episode 7

Blue Table Talk Episode 6

Look am all

Blue Table Talk Episode 4

Blue Table Talk Episode 3

Blue Table Talk Episode 2

Identifying opportunities in Nigeria for economic empowerment and other CSO initiatives local and foreign...

Look am all

Returnee from Libya warn Nigerians against irregular waka abroad

Nigerian returnee, Jubril Bukar, don caution Nigerians against going on irregular waka abroad waka to Libya. !I beg Nigerians make dem no think of wakaing to Libya,” he tell TVC news. Bukar, who dey from Gwoza, Borno State, Northeast Nigeria, arrive to Lagos from Libya on 24 October. He dey among a gropu of 141 Nigerian waka abroad pipu wey dey stranded for Libya and decide to return by demsef. Bukar tell journalists say him leave Nigeria for 2013 wit de hope of reaching Germany afta wan Boko Haram attack cause make dem kill him parents for im front. He don plan to cross de Mediterranean Sea irregularly but im end up dey stay for Libya. I don come back to Nigeria with notin, but I fit tal say I be professional, as I don learn plumbing work and oda handwork, talk Bukar. “I get a wife and fo

Now wey dem don come back to Nigeria: Libyan waka people tell dem tori

“E no easy at all. I get hairdressing business wey dey do well before I waka go Libya. But I don loose everytin. I also lose my mama and my 11 year old son, when I no dey around. Wen dem no fit reach me, my mama die of heart attack, while my son die as nobody dey around to take care of im. But, I tank God I come back alive. I go start again.; I believe say I fit make am for Nigeria. No more waka comot for the country.” Naomi, 30 years old. Naomi dey inside a reintegration training programme for Lagos wey de European Union (EU) and International Organization for Migration (IOM) sponsor togeda wit de Federal Government of Nigeria. Na she wit oda participants talk about deir experiences about how dem take enter back into life for Nigeria after dem send dem back home. De EU, IOM and de Federal Government of Nigeria programme dey work to epp make over 10,000 Nigerians enter back into life for Nigeria wen dem send dem back home after dem fail plenty times to waka abroad to Europe.

Look am all

Shey you be sekondri skool teacha? Make you use awa teaching material take inform ya students on waka abroad matter, so dat dem go sabi correct informate wey go help dem make beta choice for dia future. Abeg, na english we use write all dis materials wey dey here

Look am all