Giving Ogbonge Facts About Irregular Waka Abroad
If una dey consider to waka abroad or una don dey on de road already. De Migrant Project fit offer una free, korect and ogbonge informate. We fit tell una wetin be de gbege before una carry go on de waka, and wetin life really be like for de same type country wey pipu wan go. We fit hepp una sabi about legal waka abroad options, training or bizness opportunity wey dey close to home.
Korect informate wey persin fit trust on waka abroad dey very difficult to find. De media, smugglers, and even persin wey dey una community wey don already waka abroad fit give idea wey no true about de waka and life for inside de new country. Smugglers go dey lie so dem go make profit. And wetin dey true for a waka abroad persin fit no dey korect today – laws wey dey for country wey pipu dey go fit don change, and de roads fit don become hard and gbegecious. Awa local counsellor fit give una facts and korect informate if una dey consider waka abroad or if una don dey on de move. Dis include make dem talk to una for your front or over the phone where awa staff fit ansa una kweshions. Dese conversate dey always dey secret. We dey also give una informate online thru awa Facebook page. Or una fit look out for awa local event for una community befor una make final decision about waka abroad mata.