Dem don rescue over 50 Nigerian waka people wey dey travel go Italy

E never tey wey dem save Nigerian waka people wey go reach 50 for number wey dey travel go Italy for inside the big water wey dem dey call Mediterranean Sea, na so Vanguard News nak de tori. This people dey inside mamy many African people wey Libyan Coast Guards international body wey dem dey call Doctors Without Borders gbab for inside the big sea.

Vanguard talk say na MSF 21 ship na im rescue the waka people for inside the water wey dey for the west of Tripoli. The tori talk say the ship don carry 110 waka African people reach Italy. The tori come talk say for inside this 110 waka people wey the ship don carry reach Italy, say 18 na woman and one na small pikin.

Nigeria people wey dey inside the boat pass half of the people wey dey inside. The other people wey dey inside the boat na from other countries, like sub-Saharan Africa plus including two persin wey be Palestinians. The tori talk say the Libyan Coast Guard gbab another two boats wey carry waka people like that.

Person wey dey talk for Libyan Coast Guard, wey be Ayoub Qassem, talk say the first boat wey dey gbab na dat kind kpako boat wey carry 125 people. E talk say the boat don already scatter Zawiya, west Tripoli before dem gbab am. “The second boat wey carry 112 people come turn back for Garabulli, east of Tripoli. As the waka people and people wey dey do this kurukere business see say weather dey quiet and the water no dey violent, na im dey begin move many boats to cross to Italy,” na so Qassem talk.

The tori talk say the Coast Guard also don scatter and catch waka people wey don already plan how dem go take move go Italy for the place wey dem dey call Zuwara. This Zuwara na de place wey all the kurukere for this waka people to Europe dey happen. As the Coast Guard enter the place, they catch some waka people while others disappear with the big people wey dey do buying and selling of waka people.

“Na Libya na im be th main point wey waka people wey wan enter Europe for inside the sea take dey move. E don pass 600,000 people wey don enter inside Italy from Libya since four years, because they don see say security no tight for the place. The tori talk say since e don dey reach one year wey the number of waka people wey wan enter Italy from Libya don dey go down. The tori talk say this na because big people wey dey do the business wey dem dey call smugglers, don get agreement with Tripoli government say dem wan stop the bad business. Na for Libyan town wey dem dey call Sabratha, na there they reach that agreement to fight all the people wey dey encourage this bad belle business,” na so Vanguard News talk say Qassem nak the tori.

The tori again talk say this Libya Coast Guard wey European Union dey support don dey wonderful work to make sure say this evil business stop. Now, dem don dey gbab waka people boat before e go reach the place wey international vessel go carry them enter Europe.

Another person wey be oga kpatakpata for this waka people matter wey be Osita Osemene, talk say the thing don tire am. E talk this one for the training wey EU-IOM dey do for Lagos, Nigeria for people wey return from Libya. E talk say e dey pain am say upon all the efforts wey government and international agencies dey put to make sure say this evil stop, some Nigeria still dey plan how dem go travel go oyibo man country, even with all the danger wey dey inside am.

Osemene come dey advise all the people wey dey do this campaign to continue. E dey tell dem make dey no lose hope at all at all because success dey wait for dem for front.

Photo Credit: guardian.ng. Waka people wey dem rescue for inside the Mediterranean Sea

TMP – 21/05/2018