Dem wan launch place wea pepul wey survive human trafficking go get helep from loyas for Naija

The International Organization for Migration (IOM) don talk say e wan open place wea pepul wey survive human trafficking go get helep from loyas for for Edo State. IOM go support de Federal Ministry of Justice make im manage de place. 

“De centa go dey giv free legal assistance victim weda man or woman, old or yound and e go dey shap shap and very secret,” Na IOM dey yan dis one for de press statement wey dey release.

Den, de University of Lagos and de join bodi for loyas wey be de Nigerian Bar Association (NBA), go com host anoda two centas for Lagos and Delta States by de end of de year.  

Till today, Naija go continue to be a source, transit and destination country for human trafficking.

TMP_ 15/08/2020

Photo credit: Shutterstock/xtock

Photo caption: Concept of justice in Nigeria