For Libya, dem don dey kidnap, beat and even kill people wey wan commot for Naija go Obodi Oyibo – UN

The organization wey dey hol the whole country for the world together, wey dem dey call United Nations (UN), don talk say serious wahala dey for people wey wan take kurukere way enter oyibo man country. UN don talk say bad bad boys wey dey for Libya don dey kidnap, dey beat and even dey kill people wey wan follow kururkere way take enter oyibo man country.

This tori dey gidigbam for inside the report wey UN office for human rights release on 21st March. For inside that report, UN talk say the bad boys dey always kidnap people from Libya and those wey wan run commot from Obodo Nigeria and other African countries and put them for cell where dem dey beat them like animals. The report also talk say after dey don beat them like animal, dem go sell them as slaves for the place wey dem dey call “open slave market.”

The report talk say e don tey wey Libya don become easy place for Africans wey wan take kurukere way enter Obodo Oyibo. Sometimes, many of them no dey even reach Europe. Criminals go collect all their money, kidnap them, gbab them and put them for cell or even kill them. For women, dem dey rape them and force them to do ashawo work.

The second man for person wey dey write for inside the UN Human Rights, wey be Andrew Gilmour, don talk say people wey dem don take wuruwuru kill don plenty. Gilmour talk this one for inside the meeting of UN Human Rights Council.

In the report wey Reuters release, Gilmour talk say people wey dey commit all this crime na the armed groups.”

“People don dey see plenty dead bodies wey dem tie their hands in the street around Benghazi and the thing don dey happen for two years,” Gilmour said.
The man wey be Oga patata for Libya UN mission in Geneva, Adel Shaltut, also talk say Libya na victim of those who wan take kurukere way enter Europe. Shaltut talk say their men wey dey guard their water and land border, no get the power to face the kind organize crime wey dey there.

Last year ending, dem show it for inside CNN how dem dey sell those kurukere travellers as slaves for that open slave market.