No dey return migrants wey you don rescue to Libya, IOM tell Europe
The International Organization for Migration wey be IOM for short don dey warn European counris say make dem no dey return migrants wey dem don rescue to Libya. Na last week na im IOM talk dis one, sake of say de kain sufer sufer wey dose migrants dey for inside detention for Libya too much. IOM talk say dem no dey treat dem like say dem be human bein, instead dem just dey treat like animal. Na wetin make IOM dey cry beg Europe make e stop dat practis.
De IOM Oga patapata for Libya, wey be Federico Soda, nak dis tori for im tweta handle. E talk say: “Na compulsory say European must stop to dey carro dose migrant wey dem don rescue back to Libya. EU suppose to dey also helep dose countris wey dey fight dis fight against kurukere migration.”
Oga Soda go shot video for inside de same mata, where im com dey talk again say: “E don reach 6,000 migrants wey dem don gbab as dem wan run comot from Libya for dis inside year alone. As dem carry dem go back to Libya, many of dem na for inside detention na there dey com throway dem.”
TMP_ 24/07/2020
Image Credit: SHUTTERSTOCK/ Muratart
Image Caption: Coast guard patrol wey dey rush for rescue mission
Make una share dis article