Nigeria: Waka abroad action must to address de tin wey dey cause am
De Government of Nigeria don promise to stop wetin dey drive irregular waka abroad in a bid to make Nigerian waka abroad pipu no dey make de dangerous waka go Europe.
For de National Migration Dialogue wey hold for Abuja, Nigeria for December 2018, Nigeria President Muhammadu Buhari talk am again say de government dey committed to provide waka abroad pipu, refugeess and IDPs with tools wey go hepp dem stand by demselves with de social programmes and interventions wey dey ground already.
“I dey encouraged to sabi say Nigeria don make efforts for inside de fight against irregular waka abroad mata; wey pass to just approve waka abroad policy,” na wetin Buhari talk.
He talk say de government, with support from development agencies, don arrange how dem carry comot hundreds of Nigerian waka abroad pipu from Libya. Na ova 10, 000 Nigerian waka abroad pipu wey dey stranded for Libya and oda countries don return to Nigeria between April 2017 and October 2018, according to de International Organization of Migration (IOM).
Christian Eiguedo, a Libyan returnee, tell The Migrant Project why im attempt de waa to Europe. “I decide to travel abroad wen tinz dey really tough for de country. I no fit get education or moni to run my bizness so I decide make I travel to Europe thru Libya.” im talk.
Like Christian, many irregular waka abroad pipu from Nigeria dey pushed to make de dangerous waka to Europe becos of high poverty level, economic opportunities no dey and family dey put pressure. For according to IOM, na at least 2,297 people die in de Mediterranean sea or dem missing as dem dey try to reach Europe for 2018.
As part of de effort to comot de tinzs wey dey cause irregular waka abroad, President Buhari talk say de government dey continue to informate pipu wey fit waka abroad of de gbede of irregular waka abroad. De government also don introduce plenty interventions wey go hepp waka abroad pipu like how dem go invest in infrastructure to create environment wey go beta for entrepreneurs.
“This is all part of efforts aimed to eradicate the drivers of irregular migration such as poverty, unemployment, climate change, conflicts and social inequalities,” said Buhari.
“Dis na all part of efforts wey dey aimed to stop de drivers of irregular waka abroad lie poverty, unemployment, climate change, conflicts and social inequality.” talk Buhari.
TMP – 13/02/2019
Photo: Ova 50 Nigerian waka abroad pipu wey dey go Ittaly wey dem rescue for sea.
Make una share dis article