Nigerian win waka abroad business prize
Chidi Nwaogu, a young businessman from Nigeria, don win de Migration Entrepreneurship prize organized by de Human Security Division (HSD) of de Swiss Federal Department of Foreign Affairs, FDFA.
Chidi na wan of de ten winners of de prize for entrepreneurs wey get social business solution wey go reduce de helplessness of waka abroad pipu for kountries wey dey affected by waka abroad mattaz. Nigeria na major origin, transit and destination country for irregular waka abroad pipu. Nwaogu co-founded Pibliseer, a digital platform wey dey hepp filmmakers, writers and musicians for Africa dey earn above de minimum wage.
Winners of de prize dey announced by Seedstars for its first online Seedstars Summit for de £rd of April, 2020, wit ova 5,000 pipu for attendance. Seedstars na Swiss-based private group of companies wey get mission to improve lives of pipu for emerging markets thru using technology and entrepreneurship.
TMP_21/04/2020
Photo credit: Entrepreneurssquare
Photo caption: Chidi Nwaogu
Make una share dis article