“De road dey really blocked”: Travel limits dey cause big problem for irregular waka abroad pipu

Many Africans still dey try to waka abroad irregularly to Europe thru de Niger route on top say de coronavirus crisis and restrictions, Howeva, it don become hard to waka pass thru Niger make dem no catch persin as dem don tight de security and get plans to close border.  

Idrissa, a former pipu smuggler, tell AFP say it don become more hard for waka abroad pipu make dem pass well well thru Niger: “Before we fi cross small small but becos of de steps wey dem don take against coronavirus, de road don dey really blocked.”

But, waka abroad pipu still dey waka go border communities wey dey along de border of Niger and Libya, and dem dey gather for places like Madama and Dirkou. For de waka, it dey hard for irregular waka abroad pipu make dey arrange ways to prevent, like washing hand well and make dem no too near each oda, and dis dey put dem for even more risk say make dem catch de virus.

TMP_25/05/2020

Photo credit: ID:1684654351

Photo caption: Niger – September 2013: Governmental military guard in North Africa Cars with armed soldiers desert border Libya-Niger.