Rescued waka abroad pipu returned to Libya amidst fighting
More dan 50 waka abroad pipu wey dem rescue for Maltese waters don get taken back to Tripoli, Libya even though dem dey do rival fights for de North-African country, according to de International Organization for Migration (IOM). De waka abroad pipu, wey dey rescued by a Maltese commercial vessel from a blown-blown boat dey handed to de Libyan coast guard, who spend hours on a coast guard vessel before dem land for Libya’s capital where local authorities hold dem down.
Dem recover five bodies and report seven persins missing, IOM talk, as dem increase consign abot de welfare of waka abroad pipu inside de gbege wey dey grow and fighting wey dey for Tripoli. Hundreds of waka abroad pipu dey run komot from Libya as de fight dey continue, while plenty European kountries don close deir ports to waka abroad ships wit de excuse say dem dey stop make coronavirus no spread.
TMP_ 21/04/2020
Photo credit: Shutterstock/El Greco 1973
Photo caption: Malta / Malta 09/30/2015.Panoramic view of Valletta, Malta
Make una share dis article