Ship wey dey hepp waka abroad pipu no get chance to stay for any EU port
About 78 waka abroad pipu wey run komot from Libya go Europe don hook for on top sea insode ship and no get port wey dem go fit come down, na wetin International Organization for Migration (IOM) talk.
De waka abroad pipu komot from Libya becos of plenty gbege and wan vessel hepp rescue dem for 3 May, talk Safa Msehli, spokesperson for IOM. De vessel already dey European waters but no get permission to land for any port, na wetin Msehli talk. Since 2011, Libya don be major waka pass country for African and Asia waka abroad pipu wey wan try reach Europe thru kurukere ways.
TMP_ 05/05/2020
Photo credit: ShutterStock/Vladimir Melnik
Photo caption: A vessel on the Mediterranean sea
Make una share dis article