World body don join hand to helep African waka people wey don tanda for Libya
If tori wey Nigerian wey don come back from Libya dey nak na true, na im be say plenty people wey wan commot go Obodo Oyibo still dey for big gbege for that country.
E get one girl wey come back from Libya for December 27, last year. Im name na Deola Debora from Ogun State. Im talk say persin wey carry am waka lie to im grandmama say na America im wan carry am go. The girl wey be 25 years old talk say when im grandma hear America, im come happy weluwel but im no no say na Libya the man wan carry am go do ashawo work.
“My mouth no fit talk wetin I see for desert as we dey waka. I see many-many things wey I no fit remember again. I no even no where I go start dey nak the tori. I just wan make you no say the thing wey I see pass wetin my mouth fit talk.
“As we land for Libya, dey come tell me say I go pay 600 dinars wey dem take carry me reach Libya from Naija. So, the following day, dem force me to start dey do ashawo work. I no fit talk all the bad-bad things wey I see. But my brother, dem treat us like say we be slave. Dem no even wan no say you dey sick. If you like, make you die; e no concern dem. Na so other people get many-many bad experience to talk for life inside Libya,” na so Debora yan give one persin for The Migrant Project.
Na because of this many-many things wey dey happen to wakapeople wey don tanda for Libya, na im make African Union (AU), the European Union (EU) and the United Nations (UN) come join body come bring out taskforce wey go solve the problem.
After the join body come meet finish for Addis Ababa, wey be capital of Ethiopia, the AU Oga wey dey in charge of persin matta, wey be also the eye we AU take dey see for inside Libya, wey be Amira Elfadil, come tell tori people say the thing wey wakapeople dey face for Libya no be small thing. E come talk say, wakapeople wey those bad boys wey be miltia group gbab, na their own worse pass. E come dey advise say the joinbody must do something quick-quick to helep.
But, the taskforce wey joinbody form don try weluwel to send those wakapeople wey don tanda for Libya back to them countries. Nobi only say the taskforce dey send dem back go dem country, dem dey also train dem and give dem money to helep dem make dem settle down weluwel for inside dem country.
“The taskforce don send people wey pass 16,000 to dem country from Libya. Last time wey I travel go Libya wey don reach two months now, the people wey dem gbab for government camp don reduce from 20,000 in November 2017, go reach about 3,400,” na wetin Elfadil dey talk.
E come talk again say another joinbody wey be Committee of Intelligence and Security Service of Africa don dey work to make sure say dey finish all the bad-bad gang wey dey deceive people dey carry dem go Libya, to make money for dem.
Another body wey get interest for the matter wey be International Organization for Migration don talk say wakapeople wey pass 620,000 still tanda for Libya. E talk say e don tey wey many of them don dey like dat for Libya.
Regista for waka abroad informate
Make una share dis article