Dem don advise Germany to start cash-for-visa for African waka abroad pipu 

De Expert Council for German Foundations on Integration and Migration (SVR) don talk say make Germany arrange visa plan wey go allow African waka abroad pipu make dem get temporary work permit with cash deposit. De experts talk say dis system go reduce irregular waka abroad and go encourage make waka abroad pipu wan go back home by demselves wen dem visa don expire.

De policy wey dem dey suggest go allow waka abroad pipu from Africa make dem work temporarily for Germany, while dem dey save moni, and dem dey learn work which dem fit go use lata for deir country where dem come from. It go also encourage waka abroad pipu make dem return to deir country wen deir visa don finish and dem go get deir cash deposit back. 

De Council dey tell Germany and oda EU kountries make dem find new ways wey dem go take work with African kountries on top waka abroad matters.

TMP_ 11/05/2020

Photo credit: Shutterstock/vanhurck

Photo caption: Close-up of American visa with European passport