Irregular waka abroad pipu dey bigger gbege as Europe dey remove lockdown, talk Europol  

EU’s policing agency don warn say de removing of de coronavirus lockdown across Europe dey increase de gbege of irregular waka abroad pipu by organized criminals.

For de latest report, Europol note say irregular waka abroad don slow down for de coronavirus lockdown but it go come up afta dem comot de restrictions. “Loosening of travel and waka restrictions go fit increase waka of irregular waka abroad pipu..as dem no fit move for de lockdown,” talk Europol.

De report talk dat dere fit be increase for gbege of waka abroad pipu, and for de agric sector and de sex work industry. 

TMP_ 25/05/2020

Photo credit: Shutterstock/Gene Isenko

Photo caption: Migrants on a small boat, begging for help from a big cruise ship in the sea.