Italy no allow ship wey dey rescue migrant comot for park
Italy don talk say German ship, Sea-Watch 3, wey dey help to save migrants wey get gbege for inside Mediterranean Sea, no go comot for im park again.
Na on 8 July, na im the Italian Coast Guard talk say de resin dey stop de ship be say im get many many problems wey be say if dem no stop am, e fit cause accident wey go even de pepul wey wan help others and de pepul wey dem wan help, wey be de migrants.
E never too tey wey de ship rescue more than 200 migrants wey dem go quarantine for inside de Moby Zaza ferry.
TMP_ 14/07/2020
Photo credit: Shutterstock/steve estvanik
Photo caption: A ship at sea
Make una share dis article