Libya don catch many migrant, come throw dem inside prison
Libya Coastguard don gbab about 400 migrants wey wan run enter Europe from Libya. They don put them for inside prison wey dey for Tripoli. Na within 48 hours, na im the thin happen.
The UN agency wey dey handle matter for refugee don talk say they don recover two dead body for inside the sea on 25 May after they gbab 315 migrants. The UN come talk say they don carry those 315 migrants back to Libya. Before dat one, the Libyan Coastguard don gbab about 85 migrants. For only dis month of May, more than 1,000 people, na im don try make dem cross dat big water wey dem dey call the Mediterranean sea, take enter yankee from Libya.
TMP_ 29/05/2020
Photo Credit: Shutterstock/Tinnakorn Jorruang
Photo Caption: Man in prison with hands behind a steel cage.
Regista for waka abroad informate
Make una share dis article