Malta don agree say e go fight irregular migration for Libya

Malta don sign agreement with Libya to make sure say dem stop people wey dey follow Mediterranean Sea take enter Europe.

According to the agreement wey the two country sign on 28 May, dem go build two centres from where dem go stay watch wetin dey happen about kurukere travel.

The two centres go dey for Tripoli wey be capital of Libyan and Valletta wey be the capital of Malta.

E do tey wey people dey waka enter Europe from Libya and wetin this two-country wan do now be to say e don do. From January come reach April this year alone, e don pass 1,200 migrants wey don enter Malta from Libya.

TMP_06/06/2020

Photo credit: iStock/JannHuizenga

Photo caption: Some African migrants on queue to have breakfast in a restaurant