Dem don save plenty waka waka people from Africa on top Mediterranean Sea
Spain’s maritime rescue service don rescue 476 migrants on 6 May, as dey attempt de dangerous Mediterranean crossing to Europe.
De migrants wey dem rescue na from 15 small boats, which comot from Libya on 4 and 5 May. Dere no dey record of die or injury, talk news report.
Inside anoda rescue mission for de same day, de Spanish humanitarian group, Proactiva Open Arms, rescue 105 more waka abroad people on top de Mediterranean Sea off de coast of Libya.
De waka abroad people dem tal say, dem be from Nigeria, Egypt, Libya and Bangladesh. Dey find dem wey dem dey drift inside boat wey no get engine for on top de sea. De waka abroad people wey dey on board report dat smugglers wey dey sail inside different boat comot de waka abroad people’s boat engine as as dem reach half of de Mediterranean Sea, come leave dem helpless.
As de weather dey get better, to dey cross sea go likely to increase.
In recent years, na tens of thousands of waka abroad people dey try to waka go Europe by crossing de Mediterranean Sea using smugglers service inside boats wey no dey ok for de waka and de numba wey dey on top de boat, dey cause make many waka abroad people dey die every year.
De International Organization for Migration, IOM, talk say 615 waka abroad people don die as dem dey try to cross de Mediterranean for dis year.
Photo Source: premiumtimesng.com. A drifting migrant boat on the Mediterranean Sea
TMP – 29/05/2018
Regista for waka abroad informate
Make una share dis article