Effort wey Nigeria dey make to end Illegal waka abroad

Nigeria don become popular for illegal waka abroad. When dem dey talk on illegal waka abroad, the name of Nigeria must come up wella.

Dis don give the country bad image and don spoil market for plenti Nigerians, especially dose wey wan go on business trip, as dem don get many difficult experiences for foreign country, even plus include inside African countries. Dis na as a result of de plenti numba of Nigerians wey wan reach Europe through illegal waka abroad.

As de mata disturb the Federal Government of Nigeria, dem establish committee wey go addresss de issue of illegal waka abroad and trafficking of human beings.

De committee wey dey headed togeda by de Comptroller-General of Immigration, Mr Mohammed Babandede and de Edo State Attorney-General and Commissioner for Justice, Prof. Yinka Omoregbe, na to drop solutions wey fit epp issues of illegal migration and trafficking of human beings.

Na de Minister of Interior, Lt-Gen. Abdulrahman Dambazau(retired), wey do de inauguration of de committee and he mandate make de committe look at all issues of illegal migration and trafficking in human beings. “Make una no forget de fact say Nigeria na sub-transit country, so we dey also receive as we have our own wey dey comot,” na wetin he tell committee members.

“So, look all dose issues, how we go deal wit dem, with particular as dey relate to Edo State, because na from dere, most of de traffickers dey get from dere, according to statistics,” he added.

“So, look at all those issues, how to deal with them, particularly as they relate to Edo State, because most of the traffickers are sourced from there, according to statistics,” na so he add.

“No be just trafficking witin de Mediterranean Sea; we also get trafficking within de country and de region and even witin de continent,” na so de minister talk.

De Gusau Institute, a non-governmental organization, talk say dat getting to de bottom reasons for illegal waka abroad for Nigeria na de only way to comot from de problem. De institute recommend dat de wrong idea say na abroad get more and beta opportunities and it suppose dey corrected through ogbonge media messages.

“The Ministry of Foreign Affairs, wey be de lead government agency for on top international relations, suppose become more inside waka abroad and waka issues, plus include to work closely with de international community,” De Gusau Institute talk am for inside report afta de first two sessions of de G1 Roundtable Series.

De Gusau Institute’s report talk say economic development na im remain a key factor to tackle illegal waka abroad in Nigeria, even as it dey cafor de creation of wide collaboration among de local stakeholders, security agencies, and government establishments, wey dem give the work of ending trafficking of humans and illegal waka abroad. “In dis regard, correct and actionable intelligence sharing dey important, if de operations of criminal kingpins and human traffickers go dey scattered or finished.

De report come talk more say: “As consain de transit route for illegal waka abroad people wey dey follow Niger, de Minister of Interior should start talk wit de neighbor Nigeria government on how dem go address and stop de plenty number of waka abroad people wey dey pass through Niger.”

The G1 report come talk say, “the repatriation and re-integration of people wey return suppose be supported in a ain way wey go encourage people who it affect to return home and come start deir lives again with respect.”

Photo Credit: senatepresident.gov.ng. The Nigerian government is collaborating with the EU to curb irregular migration.

TMP – 28/05/2018