De 5 risks wey irregular waka abroad pipu from Nigeria dey face
De 5 risks wey irregular waka abroad pipu from Nigeria dey face
For Nigerians, moving to Europe don become more harder. Thousands don try to travel irregularly, but dem dey on deir own. Here, you go find de five main dagers wey dey face irregular waka abroad pipu from Nigeria in deir way to Europe.
Knowledge na power. Dis informate fit hepp you or persin wey you sabi. Make una read and share am.
Exploitation by people smugglers
Smugglers be criminals who dey pretend say both de journey and make persin settle for Europe dey easy so dem go collect. Smugglers dey lie plenti about how de way dem wan follow dey safe and wat transport dem go use travel pipu, particularly boats.
De United Nations don sanction human traffickers in Libya for de many crimes dem don commit. Even if dem sabi de waka abroad persin’s family and friends, smugglers go still exploit dem and go put dem for inside dangerous situation.
Adora, na 22 year old Nigeria woman, who im smuggler abandon wit another 50 pipu for inside de Sahara Desert make she die. Na only six survive. De rest die of starvation and thirst as smugglers no dey wan make waka abroad pipu carry water, becos it dey heavy.
Smugglers dey plenti times pass or sell waka abroad pipu to odas for de way. Smugglers fit also ask for moni for head of de persin from family pipu and dem fit dey violent and even kee waka abroad pipu. Some smugglers don shoot waka abroad pipu for de beach for Libya if dem no gree enta de boat.
Kidnapping and theft
Plenti tori dey of waka abroad pipu wey dem kidnap when dem wan cross Mali, Mauritania and Niger as well as wen dem dey try to comot Libya. Kidnappers go capture waka abroad pipu and call dem family make dem pay ransom. Dis dey happen plenti inside de Sahara Desert and sometimes dem dey plan in advance with driver to sell de waka abroad pipu to kidnappers for big amount of moni. Kidnappers dey often torture waka abroad pipu and dem go call deir families so so dem fit hear wetin dey shele.
Azam, 30, from Nigeria,talk say na kidnappers wey cover face capture de moto wey he dey travel inside wit about 30 pipu and dem kill de driver and three passengers. De kidnappers torture dem until deir families pay ransom.
Instead make dem support deir family, waka abroad pipu come become problem.
Thief fit also steal from waka abroad pipu as dem dey travel thru de desert and na so dem fit lose de small belonging wey dem get.
Abuse and exploitation of children and adolescents
Na african waka abroad children dey at de most risk of abuse. Na more dan three inside four shidren and young adults wey dey try to waka abroad from Sub-Saharan Africa to Europe thru de Mediterranean dey face different type of bad treatment and exploitation for deir waka. De orregular waka abroad waka dey very very dangerious for pikin. Pikin no go get education and go dey by demsef and dem go still abuse am.
Na more dan 1,200 waka abroad shidren die from 2014 come 2018 as de International Organization for Migration (IOM) don record, and na nearly half of dem die as dem dey try to cross de Mediterranean.
Dose wey dey smuggle pipu in sib-Saharan Africa don dey inject waka abroad gehs wey neva reach age with drugs wey dey harmful so dem no go carry belle, as it dey sure say dem go rape dem on deir journey from Africa to Europe.
Plenti report dey of shidren wey dey miss during irregular waka abroad dey and dem go don dey for risk of sexual and work exploitation and dm go be forced to work so dem go fit pay de smugglers back for de amount of deir waka.
Violence and exploitation of women
De irregular waka abroad waka dey particularly dangerous for women and gehs. Many women dey experience physical abuse, torture, rape, enslavement and oda forms of mental abuse. De pipu wey dey do dese include criminal gangs, smugglers, traffickers, border guards, police and fellow waka abroad pipu.
“Sometimes de man go come for nite. De man get many bois, plenti bois wey dey work wit am, wey dey beat us everi day,everi nite….Even who dey rape us almost everi nite. Rape everi nite. He say make we pay moni. If we no pay, we no go anywhere.”
- Female waka abroad persin for Libya
Nigerian women dey veri vulnerable to human trafficking and dem fit force dem to work in de sex trade for Libya and Europe. Plenti times dem de tell dem say dem go work as nanny or for hair salon, but wen dem arrive for de country, dem dey forced into prostitution.
Sometimes Nigerian women sabi say na work as prostitute dem go do, but dem no sabi say de smugglers go keep de moni or dat dem go beat dem and rape dem.
Women dey face de risk and make dem force dem into prostitution for all de stages of de waka. One waka abroad persin talk say as dem arrive for Qatrun, a village for southern Libya, na plenti women dem force to start to prostitute. If de guard think say de woman no coorperate well, dem go sell dem.
Even in Europe, detention facilities and other accommodation centres do not always meet the protection needs of women and girls, and they face multiple levels of harassment. Rape is common, even in reception centres and refugee camps in Europe.
Detention camp and oda accomodation centre no dey always meet de protection needs of women and gehs, and dem dey face many levels of harassment. Rape dey commom, even for reception centres and refugee camps for Europe.
Rejected from Europe, Nigerians return
Once dem don reach Europe, thousands of Nigerians dey get forced to return, becos dem no get legal right to dey dere. Many come irregularly and den come apply for asylum. However, as Nigeria no dey at war and de government no dey punish citizens, Nigeria no dey qualify for asylum. Nigerian application for asylum na one of de highest ones wey dem dey reject for inside all de African nationals wey dey arrive for Europe.
In 2016, na ova 20,000 Nigerians dem deny asylum for Europe and dem tell dem make dem go home. In 2018, Germany announce say it go send tens of thousands Nigerians home. De German government add say dat 99 per cent of Nigerian asylum claims go dey likely to be rejected, becos Nigeria no dey at war and de government no dey politically persecute its citizens.
Are there other options?
Dem be three legal options wey dey to migrate regularly to Europe, you go find all de informate you need about de legal avenues wey dey to Europe for here: Alternatives to irregular waka abroad for Nigerians
Pipu dey increase wey wan return to deir county Nigeria pr dem decide to stay becos of de risks and price of irregular waka abroad. Find out more about Nigerians wey dey return home: https://www.themigrantproject.org/migrants-nigeria
De good news be say: dem be numba of opportunities wey dey increase for young Nigerians to build de successful life dem dey wish for. Make una discover dem here: Ten alternatives to irregular waka abroad for Nigerians.