Nigeria

Ten alternatives to irregular migration for Nigerians

Ten alternatives to irregular migration for Nigerians

As the Libya migrant crisis revealed, irregular migration is an increasingly dangerous choice, with ever fewer chances of success. As a consequence, more Nigerian migrants now decide to return home. The good news is, there are new opportunities for young Nigerians looking for success in their motherland. What are they? And what about Nigerians looking for a legal way to travel to Europe?

As de waka abroad problem for Libya don show, irregular waka abroad na choice wey dey become more dangerous and de chance make persin succeed no come down. Becos of dis, many Nigerian waka abroad pipu dey decide to return home. De good news be say, dere don be bew opportunities for young Nigerians wey dey look for success in deir moda-land. Wetin dem be? And wat about Nigerians wey dey look for legal way to travel go Europe?

Here, una go learn about seven new opportunities wey dey Nigeria wey fit hepp with work and business, plus three legal ways you fit waka go abroad, wey una fit don no hear before.

It dey important to consider options wey dey for investing moni for home rather dan for irregular waka abroad as way to build skills and wey fit improve de economic situation of pipu wey fit become waka abroad pipu. Dere also be legal ways to travel go Europe which fit be cheaper, safer and go dey more secure.

 

Seven chances wey dey for Nigerians

Dere be many programmes and initiatives wey dey funded by international organisations as well as de Nigerian government wey get aim to support young people for inside deir effort to secure livelihoods. Dese programmes dey from job training to access to credit for young entrepreneurs. Here be seven of dem.

De Youth Entrepreneurship Development Programme (YEDP) dey supported by de Central Bank of Nigeria and dey give access to credit for young women and men who dey interested in starting and building businesses in Nigeria. YEDP dey offer credit wey reach three million naira (8,340 US dollars) for individuals or 10 million naira (27,800 US dollars) for groups of three to five at a nine percent interest rate.

De Youth Employment in Agriculture Programme na government-funded project wey support young Nigerians in deir efforts to improve agricultural productivity and engage in rural development.

De World Bank dey also support  Nigeria Youth Employment and Social Support Operation wey increase access to livelihoods for poor and vulnerable Nigerians. De programme include four components: strengthening social safety nets, a public welfare programme, a skills for jobs programme and a targeted cash transfer programme.

De World Bank also fund de government-run Nigeria Subsidy Reinvestment and Empowerment Programme, which dey give work and internships for young Nigerians. Dis programme na de umbrella initiative wey dey oversee sub-programmes wey include de Graduate Internship Scheme, de Community Services Scheme, de Vocational Training Scheme and Community Services, Women and Youth Empowerment, among others. More information about dese initiatives dey available for dis report by de Brookings Institution.

De Graduate Internship Scheme (GIS) dey offer graduates wey no get work (but wey get undergraduate degree) internship work for key sector, wey include government and small and medium enterprise. For de 1st year, GIS get 85,000 application and select 50,000 beneficiaries.

De Osun Youth Empowerment Scheme na state-level employment programme wey place participants for different types of work – wey be from traffic controller to sanitation and environmental officials.

The Emergency Trust Fund for Africa dey provide moni for different programmes wey dey for supporting Nigerians wey dey displaced plus long-term sustainable development. Na seven projects wey dey now in Nigeria wey worth nearly 80 million euros. Objective wey de programme get include make pipu get access to livelihoods, to improve quality of service wey dey and make dem make community safety beta.

3 legal waka abroad options to Europe

Dere be plenti legal waka abroad options for Nigerians to live, study or work for Europe.

The European Union Blue Card Work Visa Scheme. De European Union (EU) get a scheme wey dem dey use to  bring in talent from oda countries like Nigeria called de EU Blue Card scheme. In 2016, dem review de scheme and while it still dey put eye for high-skilled waka abroad pipu, dem done bring de salary requirement down, which don make more waka abroad pipu fit get am. Blue card dey available to pipu wey good in area like information technology or academic research. Dis route get advantage of making sure say waka abroad pipu get job wey sure in advance and dem fit travel safely and legally.

Family reunification. If direct family member get refugee status or legal permanent residency for European country, it dey possible dat spouse, parent or child fit join dem.

Student visas. Dose wey dem accept into European university who fit pay de fees fit apply for student visa wey go allow dem study, travel and work (part-time). Tuition fee fit cheap pass irregular waka abroad. Bachelor’s degree for University of Amsterdam, for example, na around 9,000 euros.

Sabi de risks, consider options

De things and tori wey Nigerian waka abroad pipu talk show de real cost of de waka to Europe when travelling irregularly. Sabing de wahala wey it don become for irregular waka abroad pipu and deir families – many no get anything again – one may wan consider oda options before one go risking one’s life on top dangerous attempt to reach and stay for Europe without visa.

Una don consider to waka go ECOWAS region? It dey safer, cheaper and legal for Nigerians to go to de countries wey dey de ECOWAS region, wey include Benin, Burkina Faso, Cabo Verde, Côte d’Ivoire, The Gambia, Ghana, Guinea, Guinea Bissau, Liberia, Mali, Niger, Nigeria, Senegal, Sierra Leone and Togo.

Una dey consider going to North Africa and den crossing de Mediterranean Sea to Europe? Dem be five risks una suppose don sabi before una make dis decision. Una go also find description wey go show una well well de living conditions for Nigerian waka abroad pipu for each step of de waka for here,

Una find dis informate useful? Share am with friends and relatives for social media.

 

Subscription for newsletter

Make una sign up and get de latest waka abroad tori
Success - we'll be in touch shortly
Sorry! Please try again.