Hundreds of waka abroad pipu wey dem caught off Libya coast and returned to detention centres
Almost 500 waka abroad pipu wey dey try to reach Europe on top blown-blown rubber boat don get caught by Libya’s coastguard during six operations ova de course of wan week in September 2019. Dem catch de waka abroad pipu for along de northeast and northwest corridors of Tripoli.
De group of waka abroad pipu from sub-Saharan, Asian and Middle Eastern countries include 28 women and five shidren. Dem move dem to different detention centres wey government dey run, according to Ayoub Quassem, coastguard spokesperson.
Qasem talk say dat 173 of de waka abroad pipu don dey moved to Komas, 166 to Tripoli, 50 to Zawiya, and 104 to Zuwarah. Detention centres for Libya dey notorious for deir obgonge conditions such as no way to get healthcare, food and water wey clean, and violence.
For recent time, 71 waka abroad pipu on top a blownblown boat dey rescued on 29 September 2019 afta dem spend four days for sea. De waka aborad pipu, however, run comot from de authorities afta dem return dem to Libya.
For statement wey dem issue on 3 October 2019, de Libyan coastguard talk say it stop anoda 102 Europe-going waka abroad pipu for a rubber boat.
De waka abroad pipu, including three women and a pikin, were stopped on 1 October 2019 while dem dey try to cross de Mediterranean near de capital Tripoli. Dem take dem to a detention centre in Khom, wey be around 120 kilometres east of Tripoli.
Libya, for recent years, don become a major transit country for waka abroad pipu wey dey run from poverty and war and wey dey try to reach Europe thru irregular road in search of beta opportunity to make moni. De United Nations don call for de closure of all detention centres for Libya afta airstrike kill ova 60 waka abroad pipu and injury more dan 130 for July 2019.
TMP 04/11/2019
Photo credit: By Massimo Todaro
Photo caption: North African waka abroad pipu and refugees for ship for de port of Taranto, Puglia, Italy – August 2015 – Image
Make una share dis article