Migrants wey don dey ontop Mediterranean sea for many weeks don come down for Malta side  

Na about 425 migrants wey don lose hope ontop Mediterranean Sea for many weeks, na im we hear say dem don allow dem come down for Malta side.

We hear say dem gbab de migrants wey dey run away from Libya to Europe for de coast of Malta. We also hear say na de fear of Coronavirus na im make de Malta govment no allow de migrants wey carry four tourist vessels land for dea country. But, as de pepul come begin make trouble, de thin come become too much, na im make de Malta govment come allow dem come down for dea country on June 7. Na Malta govment na im talk dis one.

TMP_ 10/06/2020

Photo credit: ShutterStock/Ververidis Vasilis

Photo caption: Thessaloniki, Greece – Sept 3, 2019: Refugees and migrants disembark to the port of Thessaloniki after being transferred from the refugee camp of Moria, Lesvos island.