From Nigeria to Libya and Europe: de risks wey dey de journey
From Nigeria to Libya and Europe: de risks wey dey de journey
Many Nigerians don die as dem dey try to reach Libya, and many more don died as dem dey cross de Mediterranean Sea go Italy. For down, you go find de major danja fro irregular waka abroad pipu for each step of de long and ogbonge danjarous waka from Nigeria to Liby and as dem waka go Europe.
Waka abroad pipu dey have to travel thru plenty different contries and dey experience plenty danja on deir way to where dem dey go wey be Europe. For Nigerian waka abroad pipu, Libya na dead end, as de gbege crisis wey happen for 2017 show. But, dem still dey oda serious risks wey persin suppose sabi about. Dis na informate wey fit save life.
Wat waka abroad pipu dey go thru in Niger
For 2017, Niger pass anti-smuggling laws and dey actively fight smuggling, wit de hepp of de European Union (EU), wich dey train deir security forces. For 2016, de security forces arrest almost 300 smugglers and confisticate 170 trucks wey dem dey use to transport waka abroad pipu for Agadez. Dis don make smugglers to increase deir prices and more kidnap for ransom don dey happen.
A shop owner for Agadez confess say dat since waka abroad pipu now dey hide for inside ghettos, “dey no fit check de local market prices so we fit charge dem double or even three times de price.”
Waka abroad pipu dey hide for compounds for Agadez, wey be de waka abroad waka waka pass town, so dem no go arrest dem. Dem no dey get enuf moni dere, as Agadz dey costly for waka abroad pipu.
Dose who no dey speak French, like Nigerians, dey very exposed, wan Nigerian teenage geh talk say she have to work as a prostitute for waka abroad compound in Agadez so she go fit save moni. It take am 18 months before she fit make enuf moni to comot.
De jobs wey dey Agadez no dey plenty, becos waka abroad pipu must to hide from de police and dem no dey speak de language. Nigerian waka abroad pipu dey hang for Agadez with no moni wey dem go use continue deir waka or to even comot back home. If dem wan leave, dey must rely on family wey go support dem.
A gbege waka across de Sahara Desert
Dere fit be more waka abroad pipu wey dey die for inside Sahara Desert dan for sea. De Sahara Desert na big place wey no get goferment, and dere be many criminal gangs and thiefs wey dey attack and kidnap waka broad pipu or dey steal deir belongings.
De waka thru de desert fit take weeks. De place dey difficult, and e temperature dey high for daytime so moto fit spoil, and waka abroad pipu go hang for inside desert.
For dis kain situation, or where moto spoil, waka abroad pipu fit die of starving and from de heat. Sometimes sef, waka abroad pipu dey suffocate and die for back of truck and dem no go find de bodi until dem wan offload de truck for Libya. Pipu dey also die wen dem fall comot from overload moto. Waka abroad pipu dey talk say dem dey pass dead bodi for road plenti plenti.
Dere don dey plenty official report of hundreds of dead bodi wey dem find for inside de Sahara. De numba go likely dey higher, but nobody sabi, as de desert dey so large and no get road. Many waka abroad pipu bodi don become buried in sand and wey dem no dey find.
A waka abroad returnee talk say. “As we dey waka from Niger to Saba, our moto spoil for desert. We dey with two Nigerian women for de moto, and de driver tal say make all of us comot come push de moto. De women talk say dem be women and de sun dey too hot, make dem excuse dem. De driver chook two of dem to death.”
For recent time now, de military don start to dey patrol de main ways wey dey reach de Libyan border, and dere be thousands of cases where driver don abandon waka abroad pipu for Sahara as dem dey fear to go prison.
Libya: dead end for many Nigerian waka abroad pipu
Libya na very unstable place wey no get single goferment. Waka abroad pipu dey get arrested often and dey for detention centres, wey dey unda de control of militias and armed group who dey see waka abroad pipu as easy way to make moni.
Mohammed, a waka abroad persin, dey forLibya and em punish fro wan detention camp. De militia call him papa and mama plenty times to ask for moni, but dem no fit afford to pay. He manange escape afta two years.
De water and food wey dey inside detention camp for Libya dey very small, and dem dey beat, rape and kill waka abroad pipu. Some dey die of starving and bad health. Detention camps also dey overcrowded and na standing waka abroad pipu dey use sleep.
If de detention camp or waka abroad warehouse don dey too full, or if waka abroad pipu no get enuf moni to pay deir smugglers, dem fit sell dem for slave markets and fit force dem to work. Many women don end up for inside sex slavery.
Inside all, na almost 50% of Nigerian waka abroad pipu wey Seefar talk to don see say dem kill persin and na almost all don experience or see where dem injure persin or beat dem.
An ogbonge gbege waka across de Mediterranean Sea (Libya to Italy)
It dey difficult to enta boat in Libya as de beaches dey patrolled, and waka abroad pipu dey get arrested often. Wit hepp from de European Union, dere be increase numba of Libya coastguards wey dey trained to stop smuggling boats in de Mediterranean Sea. Once dem dey for sea, many boats dey get to have to return to Libya, and waka abroad pipu dey put for inside detention camps again. Waka abroad pipu don pay money to agent to put dem for boat, but de agents don take deir moni and run away.
Smugglers dey lie about how long de waka go be and no dey waka abroad say de boats go carry overload and no dey good for long sea waka and dey at risk of sinking.
For 2017, na one for inside every 36 waka abroad persin die as dem dey try to cross de Mediterranean, and since 2014 16,850 waka abroad pipu don die as dem dey cross. Many of dem na Nigerians.
Smugglers don shoot waka abroad pipu on de beach for Libya if dem refuse to get on de boat, and de Libyan coastguard don also shoot at waka abroad boats wey dey carry Nigerians.
Travel for inside Europe fit dey risky for irregular waka abroad pipu
“Waka to and for inside Europe for refugees and waka abroad pipu still dey full of danja,” talk Pascale Moreau, director of UNHCR’s Europe Bureau. European border control dey very hard. For each border dere be high chance say dem fit arrest and return to Nigeria.
Smugglers dey hide waka abroad pipu for trucks and boot of moto. Sometimes de waka abroad persin dey get trapped and fit die dere. Waka abroad pipu go need to cross hard land, wey include mountains, forests and rivers, for days and em no get where to stay and for winter, inside very cold and harsh weada.
Nigerian waka abroad pipu fit return safely
More numba of irregular Nigerian waka abroad pipu don dey choose to return. Thousands of Nigerians don get repatriated to Nigeria from Libya unda de voluntary return and rehabilitation programme wey de International Organization for Migration (IOM) get, which dem dey do in partnership wit de European Union (EU).
Alhaji Mustapha Maihaja, de Director-General of de National Emergency Management Agency (NEMA), talk say dem dey collaborate wit IOM to make sure say de Nigerians wey dey stranded for Libya go get back home. “We dey here to make sure dey are received well, we dey feed and give dem moni to hel dem get back to where dem wan go,” he talk.
More numba of Nigerians dey return to de country or dem dey decide to stay as dem don sabi de risks and price of irregular waka abroad. Make una find out more about Nigerians wey dey return home: