Migration to Europe: Wetin una suppose know
Migration to Europe: Wetin una suppose know
Many Nigerians think say Europe na place wey moni, job and beta life full berekete. But, wetin be de truth? “We think say life dey better pass for Europe dan for Africa, but life here dey very tough.” Na wetin wan West African waka abroad persin wey dey Italy dey yarn be this ooo. Shey na true? Ok, check out for wetin una suppose sabi about migration policies and de way wey Europe take dey see waka abroad pipu wey go illegally.
Asylum seeker, migrant, refugees……..Wetin it really mean
Dat word “migrant” mean people wey commot for deir country go anoda man country, weda de person dey claim asylum because e dey afraid of im life, or e wan just join family members and friends or e wan beta life.
Asylum seeker na person wey run commot for im country because of persecution or serious harm, come apply for international protection and refugee status for anoda country. Even if asylum seekers dey enter anoda man country by kurukere way, de Refugee Convention say dey must get protection for dat country where dem dey first, so dat later dem go check de reason wey dem give weluwel.
When dem don accept asylum application, den de person go become a refugee. So, a refugee na person wey im asylum application don become successful and dem come allow am make im stay for some time for dat country, because dey don prove say dem go face persecution or serious harm if dey go back home.
Any asylum seeker wey dem don reject must kiakia leave de country wey don reject im application. Dey fit deport de person just like dem dey deport oda kurukere waka abroad persin.
Irregular (migrant) waka abroad persin na persin wey enter anoda persin country by kurukere way; e no get correct travel documents or a valid visa, so therefore, e no get any legal right to stay for dat country.
Again, economic (migrant) waka abroad persin and a refugee no be de same thing. Economic waka abroad persin na person wey voluntarily go to anoda man country to get beta life. If dat kain waka abroad persin go to a country wey e no get correct papers, dey fit arrest am and even deport am back to im country.
Border control, irregular migration and asylum seekers
Govement suppose know people wey dey enter and dose wey dey commot for de country, so dat dem go secure public services and protect citizens from bad belle people, drugs and crime. For inside, increased restrictions and “push backs” don force migrants to look for alternative route. Dis alternative dey always dey dangerous to follow reach deir destinations.
Countries for inside European Union (EU) don sign de UN Refugee Convention, wey go help wey follow e rules. Dey wan control deir borders so dat dem go fit check migrants wey qualify to enter dem countries as refugees.
Countries for Europe don dey change laws about kurukere waka abroad pipu.
Many countries for Europe don dey pass laws wey go make am easy to arrest kurukere migrants, detain, before dem go deport dem.
Since May 2018, wey new party take ova govement for Italy, dem don dey show red eye for kurukere migrants. De new party wey be Five Star Movement no dey laugh at all with kurukere migrant; deir eye strong weluwel for dat mata. Even as dem dey campaign before election, dem don talk say dem go deport 500,000 kurukere immigrants. So, when de interior minister come dey yan tell migrants ‘to get ready to pack deir bags,’ in June 2018, e no surprise anybody. For some months now, Italy no dey gree make migrant boats land for dem country, and dis don make many migrants dey stranded for inside as dem no fit find where to park.
De same thing don happen for inside France wey be say dem don double de amount wey kurukere migrant dey pay if dem catch dem since April 2018. France don already bring anoda law wey be say any kurukere waka abroad persin wey dem catch for inside France go enter prison go spend one year dere.
Austria, wey elect govement wey get strong anti- waka abroad position for de end of 2017, carry EU Presidency in July 2018. De Australian govement talk say it wan use its presidency to push make EU respond harder to irregular waka abroad matas. De new govement also announce plans to cut de numba of asylum seekers it go accept, de support dey receive and to permit say make dem collect and destroy de property of irregular waka abroad pipu like deir phones.
Hungary pass law wey go allow dem to automatically detain irregular waka abroad pipu and employed more officers for border. For June 2018m de parliament of Hungary pass law wey criminalize indivuduals or groups wey dey hepp irregular waka abroad pipu finding asylum.
In 2017, Poland and Slovania, announce ways wey dem go close deir borders to pipu wey dey find asylum.
De Danish govement don pass law wey allow police to seize irregular waka abroad pipu property wen dem enter de country.
The United Kingdom (UK) dey comot from de EU. Waka abroad mata na part of de debate wey lead to Brexit. Security for Border go likely be more strict in de UK.
De Netherlands don increase border security wey go stop irregular waka abroad pipu from going to de UK thru deir ports.
In March 2016 de EU sign agreement with Turkey to stop irregular waka abroad pipu entering Europe. Dem agree dat any irregular waka abroad persin wey enter de EU thru Turkey go be returned to Turkey.
Even German govement don tight de control for kurukere migrant for deir country since July 2018. Deir police don dey deal direct with migrant transit processing centres to make sure say dey control migrant wey wan enter deir country.
European countries don dey support transit countries make dem for change deir laws
Many countries don dey change deir laws to make sure say e no dey easy for kurukere migrants to enter, pass thru or even settle down.
See some example for under here
EU don help Niger commot law wey go help dem train persin wey go fight smuggler since 2017. For inside 2016, dem don arrest bad belle people wey reach 300, and 170 trucks wey dey transport migrants for Agadez. Because of dis, bad belle people don increase de money wey dem dey collect from waka abroad pipu and dis don increase kidnapping also. Agadez wey be transit town, don turn to a place wey waka abroad pipu dey hide make dem no arrest dem. Dat wan don make Agadez very expensive place to stay for Nigerian waka abroad pipu.
De EU don dey also train Libyan coastguard make dem dey prepared weluwel to catch migrants wey wan enter Europe from deir coast to de Mediterranean Sea. Migrants wey dem catch for Libyan waters, dem go send dem back to Libya. Libya don ban NGO rescue operations, say make dem no dey enter water wey dey for deir coast. De NGO wey be Doctors Without Borders don decide say dem go suspend migrant rescue operations for dat Libya coast becos de coastguard don dey threaten dem too much.
Oda alternatives for Nigerians wey dey look for new opportunities
If una neva know, make una know say beta things full ground wey person fit do to make big moni for Naija. And for dose wey no wan stay for Naija, beta correct ways wey dem go take waka enter Europe full ground.
Make you find dose new opportunities for Nigerians here.
How you find dis informate; shey e dey useful? Make una share am with una friends and relatives for social media.