Nigeria

Irregular waka abroad to Europe: wetin be de cost for Nigerians?

Irregular waka abroad to Europe: wetin be de cost for Nigerians?

Una dey wonder how much it cost to travel to Europe irregularly? Here, una go discover how much irregular waka abroad to Europe from Nigeria dey cost truly, from de pipu wey don experience am demselves. Warning: de answer fit surprise una.

Many don consider say to travel from Nigeria to Europe fit be smart move. But  many irregular waka abroad pipu don return to Nigeria poorer dan when dem comot, as dem have to spend more dan dem expect for de waka, to come back befor dem reach Europe or dem fit no get a job once dem reach dere.

Wetin be de real cost of irregular waka abroad from Nigeria to Europe.

Irregular waka abroad dey expensive and na risky decision.

Many irregular waka abroad pipu from Nigeria dey choose to to travel irregularly to Europe, becos dem wan make more moni. However, many of dem dey end up poorer and dem dey risk deir lives wen dem dey try reach Europe thru de Mediterranean Sea.

Afta dem don face smugglers and oda gbege, many waka abroad pipu dey come back to Nigeria. Deir waka dey last for months, sometimes even years, and many waka abroad pipu dey come back poorer dan dem be before dem comot Nigeria.

It dey important to think am well about weda irregular waka abroad na indeed a way to get de beta life. For too many, leaving Nigeria for Europe irregularly don mean debt and poverty.

I be danfo (minibus) driver, but I sell am to waka go Europe. My family borrow money to bail me comot for de detention camp in Libya. I no get anytin left. I come back empty.”

Nigerian returned waka abroad persin

De high price irregular Nigerian waka abroad pipu dey pay for on de road

Waka abroad pipu also dey get trapped in places like Niger and Libya and dem no fit return, becos dem no get moni to go home or continue deir waka. De waka dey often cost more dan pipu dey expect, because waka abroad pipu dey get robbed for de way or smugglers dey lie about de costs and den dem go demand for more moni.

For inside wan year, from May 2017 to de same month for 2018, na almost 7,000 Nigerians don decide to come back to Nigeria, becos life for Libya dey very dangerous. Libya don start to comot tens of thousands of Nigerians. For mani Nigerians, Libya don become dead end, meaning dem no get moni again.

Interviewed in Libya, Nigerian waka abroad pipu in Libya say dem don experience:

  • Say dem kip dem trap dem for prison and detention camps with small food, water and or elektricity
  • Seein as dem dey beat and even dey kill Nigerian and oda waka abroad pipu
  • Slave market and wen dem dey force pipu to work and dem no pay dem
  • Regular rape and violence
  • Kidnapping by criminals who go call de families and dem go ask for moni before dem go release dem

How much it dey cost a Nigerian waka abroad persin to reach Europe irregularly?

Dat no be de story wey una expect. Everi waka abroad persin dey get hope wey high and dey dream of moni. Dem dey tell each oda how it go beta as dem dey plan for de waka. But here na why many waka abroad pipu dey hide from deir friends and pipu wey sabi dem: de real cost wey dem pay to make am reach Europe.

Waka abroad pipu dey end up in debt and dem dey loose moni when dem try to travel to Europe. Smugglers dey talk say de route dey safe and promise say dem go get work on de way and for inside Europe. Dis no true.

Wen waka abroad pipu strart dem waka, dem no dey sabi how much it go cost. Smugglers often dey ask for more moni or dem dey change de prices according to security risk, and mani waka abroad pipu need to pay ransom moni make dem free dem or to bribe smugglers and officials.

The real price of the irregular journey from Nigeria

Seefar talk to mani pipu who wan become waka abroad pipu and dese pipu talk say, dem think de waka suppose no cost pass around 1,000 US dollars, odas estimate say it fit cost around 4,000 to 6,000 US dollars. However, de journey cost far more dan dis. In fact, some Nigerian waka abroad pipu talk say it fit cost up to 24,000 US dollars.

Here be de list of fees wey Nigerians who travel irregulary have to pay as dem dey waka Europe.

De waka across de sea from Libya to Europe dey cost about 3,000 US dollars alone. A Nigerian waka abroad persin in Libya tell Seefar say he choose to return from Libya to Nigeria as he no fit pay de 3,000 US dollars de smugglers dey ask for make dem dem carry him across de sea to Italy.

Travelling once una don reach Europe dey very expensive as well. A waka abroad persin tell Seefar say smugglers dey charge around 5,000 US dollars to travel from Calais on de coast of France to de UK, for example.

Trying to reach Europe thru smuggling dey veri veri expensive, but it aslo dey risky and no dey reliable. Smugglers dey lie to deir clients: dem no fit guarantee say dem go reach de European continent. Many irregular waka abroad pipu die for de waka, are arrested by security forces, end up for detention camp or dem force dem to return.

Even apart from de cost of travel, waka abroad pipu also need moni for food and accommodation along de way plus de bribe and ransom dem go pay. In some cases, waka abroad pipu talk say dem dey only pay half of de cost at de beginning of de waka with de rest wey dem go need to pay as dem dey go or wen dem reach where dem dey go.

Waka abroad pipu dey easy to exploit and traffick as de system wey dem go dem pay in stages put dem in de smugglers’ debt. It fit take mani years to pay back de moni wey dem borrow. Nigerian wome dey often forced to work as prostitutes so dem go pay back de moni.

Mani waka abroad pipu don dey get forced to return from Europe, becos dem no get legal right to be der4e. without legal papers granting asylum or de right to live and work in Europe, Nigerians no fit get work legally and dem fit run out of moni. Instead of supporting deir families, waka abroad have to ask for moni from dem.

Subscription for newsletter

Make una sign up and get de latest waka abroad tori
Success - we'll be in touch shortly
Sorry! Please try again.