Nigeria: Lagos don set up task force wey go fight human trafikin 

Governor of Lagos State wey be Babajide Sanwo-Olu don set up task force wey go fight human trafikin. E don tell de task force say make dem do beta plan wey go helep to make sure say dem stop de human trafikin buznes wey don dey grow for Lagos.

E don reach like 2,884 pepul from Lagos State wey dey don save from dose bad bele human trafiker since 16 years ago,  na de oga patapata for de National Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP), wey Dame Julie Okah-Donli, na im talk dis one during de time wen e dey lunch de task force on 8 September.

TMP_16/09/2020

Photo credit: LASG

Photo caption: Lagos State Governor, Mr Babajide Sanwo-Olu, flanked by State officers and members of the newly inaugurated Lagos Task Force on Human Trafficking.