Life for Europe: de reality for Nigerian irregular waka abroad pipu
Life for Europe: de reality for Nigerian irregular waka abroad pipu
Many Nigerians dey risk deir lives and dey lose moni and opportunity to make moni and work by attempting to waka abroad irregularly to Europe. But wetin be de situation for inside de European countries? Here, we go share some informate wey key, wey everi waka abroad persin wey no get papers suppose now when im dey cross European border suppose know.
Dis fit save una life, time, moni and energy.
How irregular waka abroad pipu fit find job for Europe?
Finding work for Europe dey veri different from finding work for Nigeria. First waka abroad pipu need visa. De employment market dey much more formal and everione must get official papers wey be like passports, working visas and transcripts so dem go fit find work. Dere be special law enforcement agencies, wey dem call labour inspectorates, wey dem job be to sabi illegal workers.
Large numba of waka broad pipu from Nigeria wey wan go no sabi de knowledge on de policies of de country dem wan go and dem dey carry expectations wey no fit happen about wetin dem go find for ground wen dem arrive. For example, in research wey Seefar do 20% of Nigerians wey dem interview expect say dem go become citizens of de country dem dey go, which no dey common for asylum seekers from West Africa.
72% of Nigerian pipu wey wan waka abroad talk say dem expect say government go support dem to find work for de country wey dem dey go. 9 for inside 10 expect say dem go find work for de country within four months.
Waka abroad pipu wey no get papers no fit find work and government no dey give support. Dose who dey work illegally fit get arrested. Some pipu dem dey wor for sabi dis and fit threaten say dem go deport dem and dem dey use dis to get control ova dem.
De unemployment rate dey high in some European countries, particularly for dem young pipu. Countries like Italy and Greece get similar unemployment rates to Nigeria. Many Europeans no fit find work and it dey even more harder for waka abroad pipu wey no fit speak de language.
Una don eva thin am say, wetin be de skills one go need to find work for Europe? De type of work wey dey available for Europe dey different and need different skills. Qualifications wey persin carry come from Nigeria fit no dey recognised by employers for Europe. Infact waka abroad pipu no dey most times get de skills wey dey necessary to find work for Europe.
Say una sabi how to speak and write de language of de country una dey go dey veri veri important to fit manage freely. Reading and writing a language dey necessary to find work for inside most European countries.
About Nigerians wey dey find asylum for inside Europe
Some Nigerians dey apply for asylum. But as Nigeria no dey for war and government no use system oppress de pipu. Nigerians no dey eligible for asylum. Nigerian application for asylum, na im dey get de highest rate of rejection for all African nationals wey dey arrive for Europe. .
For 2016, na ova 20,000 Nigerians dem deny asylum and wey dem tell to return home as dem no get legal right to be in Europe. Germany dey plan to repatriate 30,000 irregular waka abroad Nigerians wey dem deny asylum.
De cost of living for Europe
De daily cost for Europe, like accommodation, transport and food, dey veri high. For many European countries, de average family go spend around 700 US dollars per week to live. In de United Kingdom, de cost of living for a waka abroad persin na 589 pounds per week. Dese numbas no dey too different in oda European countries wey dem wan go.
Waka abroad pipu wey dey in Europe illegally dey have a hard time to find work and government no dey give any support. Without work, it dey impossible to find housing, buy enuf food or save moni.
Life wen persin arrive for Italy
Life for Italy fit dey veri hard for African waka abroad pipu. Years afta arriving, some no fit afford food, not to talk of rent. Wan Nigerian waka abroad persin who dey live for camp in northern Italy talk say: “Work no really dey here for us, na just hardship, pain and suffering.”
Becos house no dey available for irregular waka abroad pipu, many dey live for shacks and tents for camps wey no dey safe and dey veri cold for winter. In January 2018, one camp catch fire and destroyed. Wan waka abroad persin die and odas injure and lost all de things wey dem get.
Even dose wey don get residence permit dey most times no get work. For a waka abroad pipu complex inside northern Italy for example, 90% of de waka abroad pipu no get work. An African wka abroad persin talk say he don dey Italy since 2011 but neva don find work and he dey survive by food wey he dey take from dustbin.
It don dey well known say Nigerian traffickers get connection for inside migrant reception centres for Italy. Dem dey collect young women from de reception centres and force dem into prostitution and take most of de moni wey dem make. Dese traffickers dey very powerful and dangrious and dey threaten de families of waka abroad pipu for home if dem no obey deir orders.
More Nigerians dey decide to return
European countries don dey change deir laws and policies towards waka abrod pipu, wey dey force more numba of irregular waka abroad pipu to return. Find out more by reading
A waka abroad persin fit return home by himsef. It be a voluntary return if na assisted or independent return to de country of origin, transit or anoda third country wey dey based on de free will of de returnee, na im be say, na de returnee choose by himsef to go back. Plenti European countries now don dey have voluntary return scheme, which mean say dat dey support waka abroad pipu who don choose say dem wan go back to deir country of origin. You fit get assistance for voluntary return.
Oda wise, na forced return, which mean say na by force return of de persin to de country of origin, transit or a third country on basis of an administrative or judicial act. Deportation and removals na forms of forced return.
Many Nigerians dey end up returning home poorer dan before dem leave. De good news be say, dere be new opportunities for Nigerians who decide dem wan stay or return to Nigeria. Dese opportunities include employment program and support for pipu wey wan become entrepreneurs. For more informate about dese promising programmes, read
Una find dis informate useful? Share am with friends and relatives on social media.