Germany wan dey send waka waka people back to dem country papapa
Police officers for Germany enta refugee shelter for de southern town of Ellwangen on 3 May, three days afta group of waka abroad people clash wit police say dem deport a 23 year old waka abroad person from Togo.
De operation come as ne “master plan on waka abroad matter” which German Interior Minister Horst Seehofer just carry comot.
Seehofer promised tougher action to curb illegal immigration, accelerate asylum procedures and speed up the deportation of rejected asylum seekers.
Seehofer don promise say action to stop illegal waka abroad go dey more tough, dem go do asylum matter fast fast and go quick deport person wey dem don reject deir asylum.
“Wetin happen (in Ellwangen) na slap for de face of de people wey dey obey de law,” Seehofer tell reporters in Berlin, talk Associated Press.
“De right say dem allow you enter come stay no suppose dey insulted like dat,” Seehofer talk. He come add dat security authorities go “use all deir force and determination” to carry go court dose asylum seekers who block police from to carry out de deportation.
German police talk say de large-scale operation dey necessary because of de situation wey de officers face wen dey arrive come carry de asylum seeker dem reject.
“Dey prevent dem megaly, wit fight, by about 150 to 200 African refugees,” talk Bernhard Weber, deputy police chief inside de town of Aalen near Ellwangen.
Weber say dem make decision to enforce de deportation of de Togolese waka abroad person back to Italy, which be de place he pass wen he dey waka to Germany. According to de European Union Dublin Regulations, waka abroad people must to apply for asylum inside de first EU country dey enter.
As part of de new migration plan, Germany wan dey house asylum seekers inside central asylum centres, where dem go stay with about 1,500 oda waka abroad people for time of up to two years.
Waka abroad people no go be distributed inside de country until dem don get approve for dem application.
Judges go dey work for inside de asylum centers. Dose asylum seekers wey deir application no dey approve go be deported straight from de centres.
Seehofer also wants to increase the number of holding facilities for those who are to be deported to prevent them from evading deportation.
Seehofer also wan increase de numba of facilities wey go hold dose who dem go deport so dem no go fit escape deportation
TMP – 30/05/2018
Regista for waka abroad informate
Make una share dis article