New partner for de Netherlands plan to create waka abroad opportunities for skilled Nigerians
As part of efforts wey dey to stop irregular waka abroad from Nigeria, de Institute of International Relations in de Netherlands don express interest to partner wit de Nigerian govament to promote waka abroad opportunities wey safe and legal for skilled Nigerians.
De partnership programme dey expected to focus on de Information and Communication Technology (ICT) and agriculture sectors.
“De initiative go encourage young graduates from Ngeria make dem upscale deir skills for ICT and agriculture while dem dey de Netherlands, and return home to impact de country and create jobs and reduce poverty,” talk Monika Sie Dhian Ho, General Director of de Institute of International Relations, during a visit to de head of Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM) for 23 January.
Mrs Abike Dabiri-Erewa, de head of NIDCOM, talk say dere be need to promote safe and legal waka abroad channels in de light of de gbege wey waka abroad pipu dey face for de desert and Mediterranean sea.
For recent years, Nigeria don be major source of waka abroad pipu wey dey attempt to reach Europe via irregular routes. De national govanment recently express consign on top de increasing number of Nigerian youths wey willing to travel thru irregular ways even on top de gbege wey dey involved.
Nearly 16,000 Nigerians return by demsefs from sixteen kountries between 2017 and 2019 due to de harsh waka abroad experience dem face becos dem travel thru irregular way.
Dabiri-Erewa stress say NIDCOM go collaborate with partners wey dey de Netherlands to make Nigerian waka abroad pipu sabi de opportunity wey de Institute dey provide.
TMP – 04/03/2020
Photo credit: Igor Kardasov / Shutterstock
Photo caption: African marine engineer officer for engine control room ECR. Seamen’s work. He dey work for de computer
Make una share dis article