Germany announce new regular waka abroad opportunities for waka abroad pipu wey get skills
Germany don announce a new waka abroad law which aim to bring about 25,000 more skilled workers into de country each year, as a way to hepp maintain its workforce.
De law, which dem call de “Skilled Workers’ Immigration Act“, also get aim to promote regular waka abroad channels to skilled workers from kountries like Nigeria.
Minister of State of German Federal Chancellery, Mrs Annette Widmann-Mauz, discuss de new law on 5 February for meeting with de Federal Commissioner for Refugees, Migrants and IDPs, Mr Basheer Mohammed for Abuja, Nigeria.
De law, which dey passed by de German parliament for 7 June 2019, go become effective for 1 March 2020.
According to Widmann-Mauz, potential waka abroad pipu need to haff adequate informate on regular waka abroad channels, such as de Skills Migration Act, before dem embark on an irregular waka.
She talk say de German govament dey interested in providing informate on de dangers of irregular waka abroad while dem dey also provide alternatives for persins wey dey qualified.
“We go like to give advice and inform, but more dan dat, we go also like to offer language courses and training. Derefore, we get centres of informate and advice, which go beta de qualification, especially for de labour market,” talk Widmann-Mauz.
About 1.2 million jobs dey currently unfilled in Germany due to say specialists no dey plus population wey don old.
Nigeria don become major source of irregular waka abroad pipu for inside Germany and oda parts of Europe. For 2018, de German govament announce plans to deport 30,000 irregular waka abroad pipu from Nigeria wey dem reject deir asylum application.
As part of measures wey dem take to reduce de rate of irregular waka abroad from Nigeria to Germany, both kountries don sign Memoranda of Understanding (MoU) say dem go increase economic opportunities for de West African kountry through commerce, agriculture, and automobiles.
TMP – 07/03/2020
Photo credit: S-F / Shutterstock
Photo caption: Aerial view on Marienplatz town hall and Frauenkirche in Munich, Germany
Make una share dis article