Waka abroad tailor work programme for women wey dem traffick receive gift from Gucci
A group of Naija women wey dem traffick go Italy to foce make dem dey do sex work don get new work in a shop wey dey make bag and clothes, wey dem dey call The New Hope Tailoring Cooperative in Caserta, Italy.
De shop and de Naija women wey dey work dere, just get 4,000 meters of correct quality material wey remain from Gucci’s charity environment initiative wey dem dey call, Equilibrium. Equilibrium dey also find way to dash de material wey remain like leather and fabric to oda organisations dat dey work with groups wey dem marginalize.
Dem announce de job initiative for Rome, with fashion show wey de Nigerian tailors arrange togeda with de epp of a group of Italian students wey dey learn design, who teach dem how to draw and sew de designs of de outfits wey dey on display. De cloth get mix of Gucci silks, cottons, and satins with bright African prints.
Sista Rita Giaretta, who dey run home for rescued waka abroad pipu in de southern city of Caserta, told the New York Times about de goal of de project, wey be to give women idea about dignity through work, and dey epp dem to reduce deir need on outside epp.
“Givin dem deir dignity means make dem stand well on deir feet and believe in demselves and make it no be like situation wey need,” Giaretta talk.
Na between 10,000 and 30,000 Nigerian women dem believe say dem dey currently do sex work in Italy. Na by force dem take many of dese women to do de sex work so dem go fit pay off deir debts to de human smugglers who made arrangement for deir travel to Italy.
De Italian government don boost de funding to epp waka abroad pipu who wan leave de streets and wan enter into safe houses, but pipu wey dey talk about world issues talk say de facilities neva reach to meet de needs of de community.
TMP – 27/06/2018
Photo credit: http://www.nan.ng/business/lagos-tailors-to-begin-mass-production-of-clothes/
Regista for waka abroad informate
Make una share dis article