Nigeria don sign agreement to stop kurukere waka abroad mattaz
As part of de effort to stop kurukere waka abroad for Nigeria, de federal govament don sign agreement wit de International Centre for Migration Policy Development (ICMPD).
De agreement which dem called de “Seat Agreement” was signed for Abuja, Nigeria on 18 January, afta series of talk talk negotiation which begin for 2015.
During de signing event, Acting Director of Consular Division and Processes Reviewals, Mohammed Manu, who represent de Minister of Foreign Affairs, talk say de Nigerian govament dey consigned about de way many Nigerians dey komot de country dey look for beta economic opportunities.
“De global waka abroad gbege wey start around 2014 don bring plenty challenges to country of origin, transit or destination for de way wey dem dey handle kurukere waka abroad. Kountries stand to face dese challenges to see how dem fit handle dese challenges togeda and sometimes by demsefs,” na wetin Manu talk.
According to Manu, ICMPD is a major handler in tackling emerging migration crises.. According to Manu, ICMPD na major handler for tackling waka abroad crisis as dem dey come up. “Certainly, we sabi wetin una don do and we dey call on una to do more. We no dey happy with de way awa pipu dey pour into oda kountries. Dese na very good brains wey we fit use for dis country. So, wetin we need na massive enlightenment to see how dem fit be brought back into Nigeria and dem go fit enta back into society,” Manu talk.
Nigeria na a major source of kurukere waka abroad pipu, particularly dose wey dem try to reach Europe. About 16,000 Nigerians don dey returned from sixteen countries since April 2017.
Wit representation across 90 kountries, ICMPD talk say de agreement go provide alternative approach to waka abroad management for Nigeria.
ICMPD’s Director of Migration Dialogues and Cooperation, Martijn Pluim talk say “I dey hapi dat wit de present agreement, awa presence for inside de kontry go dey further stabilized. It go hepp us do ore activities for oda areas of de country like kurukere waka abroad, trafficking of persin, more private sector engagement and odas.”
TMP – 30/01/2020
Photo credit: Tayvay / Shutterstock
Photo caption: Aerial landscape view of Abuja City Area wey dem dey do business
Make una share dis article