Between xenophobia and solidarity: How dem dey treat waka abroad pipu for Europe  

Afta dem don overcome plenty wahala to reach Europe, many waka abroad pipu dey get hope to arrange new life for demselves for new kountry and inside community wey new. Depending on dem age, skill for language wey dem get, attitude plus oda factors, dem fit more or less likely to adapt to deir new surroundings. Howeva, how dem take intergrate dey affected by dose wey dey around dem. Some neighbor fit welcome dem; while odas fit reject dem.

Right-Wing Fanatism 

Report wey just dey published by Funke Media Group show say for 2019, refugees and asylum-seekers for Germany be victims of violent attacks for 1,620 occasions. For 118 cases, de pipu wey do de tinz na right-wing fanatics. Explosive, fire or oda weapons wey fit cause dangerous harm to bodi dey used for 260 of de cases. Na a total of 229 refugees dey injured for de attacks. Member of Parliament Ulla Jelpke talk of “a social climate which be say refugees suppose expect say dem fit attack dem for mouth and physically any time.”

Solidarity with Waka Abroad Pipu

Howeva, thankfully, many waka abroad pipu dey also report say dem get welcoming attitudes from oda pipu for inside kountries where dem go. Solidarity wit waka abroad pipu don show plenty for inside de current COVID-19 pandemic. 

Humanitarian NGOs wey dey work wit refugees dey ask say make govament take action wey go protect waka abroad pipu. NGOs for Italy, Spain and France don call say make dem close de waka abroad detention centres, as way wey dem go stop make de virus spread.

De EU don ask Greece to move waka abroad pipu wey de risk to catch de virus high pass comot from de overcrowded camps wey dey its islands, Home Affairs Commissioner Ylva Johansson tell Reuters. “We dey work togeda wit de Greek govament and de Greek authorities to agree for emergency plan wey we go use to hepp reduce de risk as much as it fit be for de hotspots wey dey overcrowded for de islands,” Johansson talk.

Moreova, de Portugese govament dey grant temporary citizenship rights to all waka abroad pipu and asylum seekers who don get residency applications wey dey go on. De decision na to make sure say everybody get access to health care as de country dey fight de sprea and effects of coronavirus.

TMP_ 19/04/2020

Photo credit: Kollawat Somsri Royalty-free stock photo ID: 1579474636

Photo caption: Geneva, Switzerland – August 4, 2019: Refugee at a Park in Geneva, Switzerland, Europe