Ship wey carry 150 waka abroad pipu don get gbege on top Mediterranean water
About 150 waka abroad pipu get rescued for de Mediterranean afta two separate operations by de Alan Kurdi ship off de coast of Libya for 6 April. But de rescue ship no get permission to land by Italy and Malta, and it don hook for sea.
“De situation wey dey on board de ALAN KURDI dey get more tense, as de rescue ship no dey okay to carry 150 pipu for long,” talk Sea-Eye, de NGO wey dey manage de ship, for statement for 10 April.
De Italian govament don mention say de coronavirus pandemic na reason why de country not fit dey considered as safe place for waka abroad pipu.
TMP_ 15/04/2020
Photo Credit: iStock/RanieriMeloni
Photo Caption: Augusta, Sicily, Italy – December 11, 2013: Waka abroad pipu stand for line for de Sicilian harbor of Augusta, near de Amphibious warfare ship San Marco.
Make una share dis article