Greece quarantine waka abroad camp ova coronavirus outbreak  

Greece don announce de lockdown of a waka abroad camp wit 2,300 pipu afta 20 waka abroad pipu test positive for COVID-19. De Ritsona camp for mainland Greece go dey closed for at least two weeks wit heavy restriction and monitoring by police. Greece’s Ministry of Migration talk say  all de pipu wey test positive for de virus no show any symptoms.

Greece record its first case of coronavirus for de waka abroad population last week afta a women wey just born pikin dey diagnosed wit de infection for hospital close to de Ritsona camp. Authorities say de discovery lead to de testing of dozens of refugees for de camp, afta which 20 of dem test positive.

De outbreak for Ritsona dey come just barely a week afta Greece call for “urgent” EU support make dem prepare incase coronavirus break out for inside de waka abroad camps. Humanitarian organisations had already raise serious concerns for waka abroad pipu wey dey live for inside overcrowded camps for de Greek islands noting say dem dey vulnerable to de coronavirus due to de lack of health facilities. 

TMP_ 06/04/2020

Photo credit: Shutterstock/Michele Brusini

Photo caption: Refugee crisis in Greece