Coronavirus leave thousands of waka abroad pipu stranded for Niger
Na more dan 2,300 waka abroad pipu, mostly Nigerians, Malians, Guineans and Cameroonians, dey stranded for six transit camps wey dey managed by de International Organization for Migration for Niger, na wetin de Guardian report. De waka abroad pipu wey waka on kurukere waka to Europe hook becos of de border closures and restrictions for Niger and oda kountries as per result of de global coronavirus gbege.
For early dis month, na 265 waka abroad pipu dey abandoned by traffickers for de Libya-Niger border before IOM come rescue dem. More dan 100 of de waka abroad pipu wey dem rescue na Nigerians who enta de waka go Europe by land on top say dere be global coronavirus gbege and say dem lock borders.
As it be say de numba of waka abroad pipu for de transit camps plenty, ION talk say de facilities wey im get done full pass and it dey find ways to send de stranded waka abroad pipu to where be deir country of origin where dem come from.
TMP_ 27/04/2020
Photo credit: Shutterstock/Troy
Photo caption: Migrant trucks from Agadez in Niger to Libya.
Make una share dis article