Spain don get legal support to dey depot migrants
Court for Spain don giv am power make im dey depot migrants wey folo kurukere way wey be Ceuta and Melilla for North Africa take enta de contri shapshap.
De tori be say de interior ministry for Spain go dey use de law wey be “express deportation” to dey send kurukre waka pepul bak to Moroco instead of processing dem for Spain. De only pepul wey Spain no go dey depot like dis na old pepul and women wey cari bele. Na 19 November na im court pas dis law and na since dat time na im human rights groups don dey para.
Everi year, na so plenti African migrants dey try to enta Spain from de land boda wey dey for Moroco, and na im be de only land boda wey conet Africa and Europe. For inside dis year alone, 1,441 migrants don cros enta Spain by land, na so de UN Refugee Agency wey be UNHCR com dey tok.
TMP_06/12/2020
Image Credit: Shutterstock/ Fede_umpe
Image Caption: Colourful houses in the Prince’s neighbourhood of Ceuta, Spain.
Make una share dis article