Dem don save many migrants for Tunisian coast
Tunisian Navy don rescue about 50 migrants wey com from many African countries afta dem don spend five days for inside de sea, na so Tunisian Defence Ministry tok.
Na for 11 January na im dem rescue de migrants wey dey inside de boat wey dey go Italy for de eastern coast wey dey Mahdia for Tunisia.
Tunisian authorities com dey yan say dem find de dead bodi of one small pikin during de time of rescue mission.
E neva too tey wey many kurukere waka abro pepul die as dem wan folo wata wey dey Tunisia take enta Europe.
TMP_21/01/2021
Photo credit: Shutterstock/Tatevosian Yana
Photo caption: The Mediterranean Sea Tunisia Mahdia
Make una share dis article