UN don resume to dey cari stranded migrants from Libya
De aroplane wey dey cari migrants wey dey stranded for Libya bak to dea countri don resume work, na so de United Nations Refugee Agency wey be UNHCR, com dey tok.
Na becos of Covid-19 pandemic na im make de flights stop since, but on 15 October 2020, de first plane com cari 150 kurukere migrants, wey com from Eritrea, Somalia and South Sudan from Libya go Niger.
De mouth wey dey speak for de UNHCR tok say nearly all de pepul wey dem cari go don enta detention before. Acordin to de informate wey dey ground, migrants wey go pass 3,400 dey inside different different detention centas wey dey for Libya now.
TMP_ 28/10/2020
Image Credit: Shutterstock/Ms Hulk
Image Caption: Libya is a frequently used transit point for irregular migrants en route to Europe.
Regista for waka abroad informate
Make una share dis article