Eight waka abroad pipu die for sea inside 24-hour period as dem dey try to reach Spain

De bodies of eight waka abroad pipu dey found inside 24-hour time for December off de coat of Spain. Dem dey among more dan 1,200 waka abroad pipu wey don die or wey don miss for de Mediterranean dis year as dem dey try reach Europe thru kurukere ways, IOM figure show dis wan.

De most recent waka abroad persin wey die dey found for a boat on 17 December afta de group dey spotted off de coast of Andalusia, Spain. Forty-seven waka abroad pipu na im dem rescue from de boat before morning and den take dem to de port of Motril, according to de spokesperson of Spain’s police force.

Just before dat, na seven waka abroad pipu dem confirm say dem die as boat wey dey carry about 100 pipu capsize for inside de Western Mediterranean Sea. Na seventy waka abroad pipu dem rescue, plus include 10 women and a baby, who dey “very poor state”, according to source wey dey in de Moroccan military.

Thousands of kurukere waka abroad pipu wey dey try to reach Europe at any cost recently don dey start to take de Moroccan-Spanish way in de Western Mediterranean Sea as option to the Libyan-Italian way in de Central Mediterranean Sea.

Ova 100,000 waka abroad pipu don arrive for Europe by sea for 2019, including almost 25,000 arrivals for Spain, according to de International Organization for Migration (IOM).

TMP – 06/01/2020

Photo credit: De Visu / Shutterstock

Photo caption: KOS, GREECE – SEP 28, 2015: Life Jackets wey dey for ground for beach. Kos island dey located just 4 kilometers from de Turkish coast and refugees dey waka come from Turkey for blowblow boat.