“Painful wait” on top rescue ship end as six EU countries accept waka abroad pipu wey strand

Afta dem don stay two weeks stranded on top ship wey rescue dem for Mediterranean, 365 waka abroad pipu, plus including 90 shidren wey nobody follow come, go now be allowed to come down for Malta. From dere, dem go divide dem and send dem to wan of de six EU country wey don offer to take dem. 

Maltese Prime Minister Joseph Muscat tweet for 23 August dat Malta “go transfer dese pipus to Maltese Armed Forces’ vessels wey dey out territorial waters, and dem go take dem onshore.”

For inside de same tweet, he talk wetin go happen afta dem don come down: “All waka abroad pipu go be relocated to oda member states: France, Germany, Ireland, Luxemborg, Portugal and Romania. None go remain for Malta.”

De decision make dem allow de ship, Ocean Viking, to bring de waka abroad pipu to de Maltese port no dey immediate. In fact, de request wey de crew make first make dem allow dem come down dey rejected by Malta and ignored by Italy.

De change of heart come afta de two French charities wey dey carry out de search and rescue missions on de boat, Medecins Sans Frontieres (MSF) and SOS Mediterranee, warn about de conditions wey dey worse for inside de boat as time dey go. Dem also talk say supplies dey finish.

Thinking deep on de two-week gbede for statement, Jay Berger, MSF project coordinator onboard de Ocean Viking, ask: “Weda it dey necessary to impose two weeks of ogbonge painful wait for pipu wey dem rescue to comot? Dese be pipu wey don run komot from ogbonge gbede conditions for deir home kountries and don suffer ogbonge abuse for Libya.” 

Berger call more on European governments make dem set up a “system wey go allow quick komot” of pipu wey dem rescue for sea.

Anoda rescue ship wey dey operated by Spanish NGO, Open Arms, dey recently stranded for 20 days with plenty waka abroad pipu wey dem rescue for inside de ship. Tension dey hot as de weeks dey go and dem need to komot de passengers for health conditions and serious wahala. 

De 83 wey remain on top de ship finally komot for de Italian island of Lampedusa for 20 August. Dem go dey relocated to several different EU kountries.

TMP 25/09/2019

Photo credit: MSF/ Hannahaa Wallace

Photo caption: Rescued pipu for de deck of de Ocean Viking