Thirteen women don pai, 8 shildren miss afta ovacrowded wakabroad boat sink near Italy

De Italian coast guard don recover de bodies of 13 female waka abroad pipu from boat wey turn ova near de Italian island of Lampedusa for 6 October. Many of dose wey dey on board de boat still dey missing, including eight shidren. Italian authorities belief say more dan 50 pipu dey on de boat which comot from Libya before it stop for Tunisia to carry more waka abroad pipu.

Na only 22 of dose wey dey onboard survive de sinking which happen as passengers rush go wan side wen dem see authorities dey come. Na only four of de 13 bodies wey dem recover na im family members fit identify, and dat include dat of a 12-year-old geh.

“De boat ne dey condition to make de crossing,” talk Italian prosecutor Salvatore Vella. In addition, none of de passengers get lifejackets.

Vella also talk say most of de passengers come from Tunisia or Sub-Saharan Africa.

Coastguard and police vessels spotted the migrant boat just after midnight, several hours after having received a call for help, a few kilometers from the coast of Lampedusa. The island of Lampedusa sits below Sicily and is a magnet for migrants seeking a new life in Europe.

Coastguard and police vessels spot de waka abroad pipu boat just afta midnight, several hours afta dem receive a call for hepp, a few kilometres from de coast of Lampedusa. De island of Lampedusa sit below Sicily and be magnet for waka abroad pipu wey dey find new life for Europe.

De waka from Tunisia to Italy, though it dey shorter dan from Libya, dey riskier as de sea dey rougher. According to Sicilian prosecutors wey dey investigate dis shipwreck case, de route from Tunisia den recently become more and more popular among refugees and waka abroad pipu wey wan attempt to reach Europe, despite de risks.

“De goal for dose wey dey leave Tunisia na to reach de Sicilian coast directly and avoid controls,” talk Vella.

Dis latest mata don bring de numba of Mediterranean waka abroad pipu deaths to more dan 1,000 dis year, renewing demands fofr measures to prevent tragedies for front. Spokesman to de UN Refugee Agency (UNHCR), Charlie Yaxley, call for de EU to resume its search and rescue operation for de Mediterranean Sea.

TMP 25/10/2019

Photo credit: Nasib Demlite/ Shutterstock.com

Photo caption: At least 13 women don pai and eight shidren go missing wen a waka abroad boat fall inside water near de island of Lampedusa.