Plenty pipu don try enta Europe tru wata dis year pass 2019  

More waka abroad pipu don enta Europe by sea dis year wen dem compare am to last year, according to de International Organization for Migration (IOM). Na total of 16, 724 waka abroad pipu and refugees wey arrive by sea between 1 January and 22 April 2020, a 16 per cent increase from de 14, 381 for arrivals for de same period last year.

Almost half of de waka abroad pipu (7,357) arrive for Greece thru de Eastern Mediterranean route, which don become de busiest route dis year. Italy record 3,310 arrival while Malta record 1,201 arrival thru de Central Mediterranean route. About 4,856 arrival dey recorded for Spain thru de Western Mediterranean route.

About 256 deaths dey recorded for de three main Mediterranean sea routes for de period unda review, compared wit 425 deaths for de same period for 2019.

TMP_ 29/04/2020

Photo credit: Shutterstock/Nicolas Economou

Photo caption: Lesvos island, Greece – 13 November 2015