Germany join hand with Nigeria against irregular waka abroad
For inside de things wey dem wan do to reduce irregular waka abroad to Europe, Germany and Nigeria don sign three Memoranda of Understanding (MoU) wey go epp increase financial opportunities for de West African country thru business, agriculture, and cars.
De join hand dey established for de visit by de German Chancellor Angela Merkel, and for dat time, she reveal say Germany go also give assistance for education and dis go increase de numba of Nigeria students wey wan study for Germany.
Nigeria don become major country of origin for irregular waka abroad pipu wey dey try to reach Germany and oda parts of Europe thru Mediterranean Sea.
Merkel describe say Nigeria get strategic important economy in Africa and it dey very important make we establish join hand arrangements wey go bring opportunities for our country and go give option for irregular waka abroad.
“As we dey prepare for dis visit, we carry de spirit of win-win. We dey in agreement say we go make an a win-win condition for de two sides by creating legal ways for waka abroad as it dey for inside oda countries.”
She add say it dey important dat young pipu sabi de dangers of irregular waka abroad, Merkel also press am say many of de stories wey dem talk about Germany no dey true and say dem no put gold on top de streets as pipu dey think.
President Mohammadu Buhari talk de position wey Nigeria carry on top irregular waka abroad saying, “I dey against any of my country pipu and women wey wan waka illegally to oda countries oda dan Nigeria, I dey hope say you sabi dat ECOWAS protocol get inside am free waka of persins, goods and services.”
He come add say, “but for dose wey dey go Europe, dis administration no support dat Nigerians go challenge de Sahara Desert plus Mediterranean becos dem feel say dem be greener pastures ova dere. We no dey support anytin illegal and unruly. You fit rememba dat about six weeks ago, we bring back about 3,000 Nigerians who dey stuck for inside Libya on deir way to Europe and you for don hear and see for television, de numba of Nigerians wey don lost for Mediterranean.”
Buhari talk say. “so, for us, dis administration dey very clear say dem no support anytin wey no dey legal and anybody wey feel dis country no offer am wat he suppose get and wey decide say im go carry mind enter Mediterranean dey do so at his own risk.”
TMP – 18/09/2018
Photo credit: www.thisdaylive.com President Buhari dey shake hand with German Chancellor Merkel for de Nigerian State House, Abuja
Make una share dis article