Thousands of girls from Delta State dey trapped for Mali as victims of trafficking and one chance
Na at least 10,000 women and gehs wey come from Delta State, Nigeria, dey trapped for insode Mali and oda African kountries where dem dey force dem to work, and for many cases na as prostitute.
Dis statistic dey announced by de Delta State Attorney-General and Commissioner for Justice, Peter Mrakpor, for 26 October inside symposium on human trafficking and irregular waka abroad mattaz.
De rise for human trafficking, irregular waka abroad mattaz and oda crimes wey dey similar na becos of de way morals and respect for human life and dignity don drop, na wetin de Attorney-General and Commissioner for Justice talk.
Mrakpor advise pipu wey come de symposium to join hand wit de Delta State Task Force on Human Trafficking and Illegal Migration and oda organisations wey dey involved make dem increase de awareness of de risks wey dey for human trafficking and irregular waka abroad for among young pipu.
He talk say: I dey call on de corp members plus include all Nigerians wey mean well, NGOs, faith-based organization, traditional rulers and community leaders make dem join hands to fight human trafficking.”
As he dey beg young pipu wey dey think about waka abroad, Mrakpor talk say: “Una no need to travel comot from dis country to be successful, na mindset. We get economy wey dey grow and wey get plenty opportunity.”
Mrakpor also blame parents wey dey sell deir property to raise moni wey deir shidren go use to carry out criminal trade and waka abroad wey no straight.
Delta State dey notorious for human trafficking and na dem be no three after Edo and Kano for de most rescued victims, according to de National Agency for de Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP). De agency talk say it rescue 11.819 Nigerians from human traffickers up to December 2018.
“Many victims dey deceived to leave where dem dey make moni chop for Nigeria for greener pasture for Mali. Some of de victims wey dem seize from Nigeria, include dose wey arrive for deir school uniforms,” talk de Director-General of NAPTIP, Julie Okah-Donli.
TMP 12/11/2019
Photo credit: PM News
Photo caption: Nigerian gehs wey dey trapped for Mali
Make una share dis article