Returnee from Libya warn Nigerians against irregular waka abroad

Nigerian returnee, Jubril Bukar, don caution Nigerians against going on irregular waka abroad waka to Libya. !I beg Nigerians make dem no think of wakaing to Libya,” he tell TVC news.

Bukar, who dey from Gwoza, Borno State, Northeast Nigeria, arrive to Lagos from Libya on 24 October. He dey among a gropu of 141 Nigerian waka abroad pipu wey dey stranded for Libya and decide to return by demsef.

Bukar tell journalists say him leave Nigeria for 2013 wit de hope of reaching Germany afta wan Boko Haram attack cause make dem kill him parents for im front. He don plan to cross de Mediterranean Sea irregularly but im end up dey stay for Libya.

I don come back to Nigeria with notin, but I fit tal say I be professional, as I don learn plumbing work and oda handwork, talk Bukar.

“I get a wife and four shidren befor I komot Nigeria, but now I don lost two shidren. Dem no fit find my wife. Wan of my shidren suppose dey Lokoja and anoda for Kaduna,” de returnee tell reportors.

De National Emergency Management Agency (NEMA) receive de recent batch of 141 waka abroad pipu from Libya for de Murtal Muhammed International Airport for Lagos. De group include 42 women, 55 men, 33 shidren and 11 infants.

At least 15,000 of Nigerians wey dey stranded for Libya don return home as part of a reintegration and rehabilitation programme wey de Government of Nigeria and de International Organisation for Migration (IOM) fund. 

For years, Libya has become a transit country for thousands of migrants attempting to reach Europe through irregular migration. In September, the Libyan government called for global support for around 707,000 irregular migrants currently in Libya. 

For years, Libya don become transit country for thousands of waka abroad pipu wey dey attempt to reach Europe thru irregular waka abroad. For September, de Libyan government call for global support for around 707,000 irregular migrants wey currently dey for Libya.

TMP 18/11/2019

Photo credit: DisIsAfrica

Photo caption: Some Nigerians wey dey stranded for Libya.