Irregular waka abroad pesins still dey risk deir lives as EU kountries don tight de borders

Recent numbas dey show dat waka from Africa to Europe as an irregular waka abroad pesin dey continue to be very dangerous. Infact, na ova 900 pipu wey don reportedly die or don miss for dis year 2019 as dem dey try to reach Europe from thru de Mediterranean Sea.

For single mata, which dem call de “worst Mediterranean tragedy” of de year by Filippo Grandi, UN High Commissioner for Refugees, na ova 150 waka abroad pesins drown or lost afta dem leave Libya to waka by sea to Italy. 

Waka abroad pipu no dey only die for sea. Many dey die on top de ogbonge physical gbege dem dey face for transit kountries.

For Libya, waka abroad pipu don be victims of serious human righrs violations, wey include torture and slavery.

For say make dem hepp bring down numba of irregular waka abroad pipu wey dey arrive,side kountries for Europe, like Italy, don dey give hepp to Libya so dem go fit manage deir water border.

As dis support give Libya strengthen, de coastguards for Libya dey patrol de ports and territorial waters wey dey de country. When dem find irregular waka abroad pipu wey dey waka go Europe, dem dey arrest dem and carry dem go detention centres.

UNHCR talk say about 6,000 waka abroad pipu dey currently held for inside detention centres for inside Libya. De conditions for many of dese centres dey extremely poor. Dere don be reports of waka abroad pipu wey dem detain as dem for de middle of de crossfire of de fight wey dey happen for Libya.

Libya no be de only North Africa country wey dey get support from Europe make dem increase de way dem dey manage deir border. For July 2019, Spain approve proposal to send EUR 30 million to hepp Morocco fight irregular waka abroad. Dis proposal follow de pledge wey of EUR 140 million wey de European Union make for de same purpose.

De European Union dey also call for more African-based processing and resettlement centres. With de support wey de block dey give, hundred of African waka abroad pipu wey dey stranded go soon get relocated to Rwanda.

TMP – 06/09/2019

Photo credit: morocco world news.

Photo caption: A Moroccan police officer stopping African migrants from flying over the bars into Spain.